Bibol Studis to de Grow for Spirit and Discipolship

Teach and shia God Word wit yur church abi Pipol thru di KLASS discipolship program wey Pastor Rick Warren don put togeda. KLASS go helep pipol for yur ministry to de grow for faith and live out God purpose.

Start KLASS Program
Abaut di Program

Abaut di Program

Wetin be KLASS?

Na Pastor Rick Warren make di KLASS discipolship trainin, and e make am so dat e go helep pastors lead dem pipol get tru spiritual growth. For pass 35 yias, dem don dey teach KLASS for Saddleback Church, and thousands of churches all ova di world don yuz am helep pipol grow for faith, build spiritual habit, and see as God dey call dem to serve oda pipol.

Dese online Kristian courses de easy to yuz and easy to change, so dat every church go fit shape am make e fit wetin dia pipol need.

Start KLASS Program

Yur Nes Step

Wetin Yu go Sabi From KLASS

Grow for Faith

Dey make yur membas de mature well-well for Spirit

De Serve wit Purpose

Dey prepia membas for ministry

Belong to one Pipol

De build relashonships wey make sense for church

Shia di Gospel

Dey encourage evangelism and crusade

De Lead wit Vishon

De raise strong church leadas

Klasses

Di Four Courses wey de di KLASS

We don divide di KLASS program into four klasses: Klass 101, Klass 201, Klass 301, and Klass 401, wey dey guide believas from di time wey dem join church family reach di time wey dem sabi di mission of dem life. Every KLASS course get Teacha Guide wey get teachin tips and transcripts from Pastor Rick Warren, plus Participant Guide wey get key points, Scriptures, and notes. We don make dis tools to de work togeda, so dat believas go fit move well-well from to de sabi di foundashon come reach to de serve oda pipol.

Klass 101

De Sabi awa Church Family

Dis na di introdukshon to Kristianity course wey dem make to helep pipol sabi di foundashon of Kristian faith, including wai to de do baptism and wai to be one church memba dey important. E fit helep niu Kristians well-well, abi pipol wey dey check out Kristianity for di fes time.

Klass 201

To de Sabi as I take de Grow for Spirit

Dis course dey focus on as yu take de grow for spirit. E dey give yu tools to build stronga praya life, sabi di Bible, and build betta relashonship wit oda believas. E go helep anybody wey won make im faith deep and build stronga foundashon for im spiritual waka.

Klass 301

Find My Ministry

Dis course dey focus on as yu go take find and yuz di special gifts and talents wey God give yu take serve oda pipol for yur church and community. E fit helep anybody wey won start church work well-well and make difference for oda pipol life.

Klass 401

To de Find My Life Mission

Dis course dey focus on as yu go take shia yur faith wit oda pipol and bikom discipol wey dey make oda discipols. E fit helep anybody wey won sabi to de shia di Gospel well-well and helep oda pipol grow for dia faith.

How E De Work

Start wit 5 Easy Steps

Regista Online

Fill di form wey yu go yuz to regista wit yur informashon.

Pick Yur Klass

Pick di KLASS wey fit yur spiritual waka.

Get Confirmashon

Get yur klass timetable and materials.

Attend & Join

Join live sesshons abi hia di rekordins.

Grow & Serve

Yuz wetin yu sabi, serve odas, and make yur faith strong well-well.

Start Yur KLASS Waka
Write yur details, pick yur klass, den get yur materials make yu start.

Class all languages

"*" indicates required fields

Name*
Select Your CLASS*